One pregnant woman say she enter hospital wit all her organs intact, but after her caesarean section she discover say something dey miss for her body.
Mrs. Barira Alhassan she was at middle aged woman whey for Gombe State, northern Nigeria, whey dey accuse doctors for State Specialist Hospital say dem remove one of her kidneys during Caesarean Section (C-section).
Allegation whey di management of State Specialist Hospital, Gombe don deny.
According to her family, medical scans whey dem do before di operation show say she get two healthy kidneys.
But after the operation was done, she come sick seriously, and further medical tests reportedly show say she now get only one kidney.
For interview with the BBC News Pidgin, the patient, Mrs Barira Alhassan, said she done the operation on April 8, 2026, and few days later she begin face serious health problems.
"Few days after the operation, I come sick seriously. I started vomiting , get serious stomach pain, my body come swell, and I feel pain anytime when visit restroom ," she said"
"Na wetin make me ask oda women wey don do C-section if dem too dey feel like dis afta operation bicos dis na di first time wey I do operation despite say I don born ten pikin," she add.

0 Comments